All You Need Sabi About Di Trending Charlie Charlie Challenge - BBC

What is Charlie Charlie?: All you need sabi about di trending Charlie Charlie challenge
Charlie Charlie challenge

Wia dis foto come from, RMD/TWITTER

6 January 2021Read am in 2 mins

"Charlie, Charlie, are you there? na di new trend wey dey burst social media.

Close to 200,000 pipo for Nigeria don use di hashtag #CharlieCharlie in di last four hours and several millions of pipo for di world don join di Charlie Charlie challenge.

How di trend take enta Nigeria? we no know but we understand say Charlie Charlie na one game wey don dey tey-tey.

Di game involve to balance two pencils on top each oda, come put for paper, wey dem write Yes or No. Players go come ask question wey Charlie go respond by moving di pencil to di direction of di Yes or No answer.

Kontinu to dey read
  • Meet di pesin behind di tweets wey yab Africa continent for social media
  • China no allow WHO investigation team enter di kontri

Plenty Nigerians don follow join di game wey some pipo claim say dey demonic.

Skip X post, 1Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Accept and kontinuWarning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Accept and kontinuWarning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Accept and kontinuWarning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Wetin be Charlie Charlie?

Charlie Charlie challenge

Wia dis foto come from, OTHERS

Charlie Charlie na Ouija board-like game wey players go write "Yes and No" on top paper, come balance two pencils for di paper.

Di players go divide one piece of paper into four quadrants, label each side wit either "Yes" or "No". Then put one pencil on one line, balance anoda one on top, come say "Charlie, Charlie, are you there?" If Charlie "answer" di pencil wey dey on top go move to one of di answers, e be like compass. You fit come begin ask Charlie any oda questions. Examples na "Charlie, I go pass my exam?" or "Charlie, I go get money?" etc.

Origin of di game

Several reports and tweets claim say di game na from Mexico. For example, one of di most retweeted videos about Charlie Charlie Challenge, shows one popular Mexican beer brand for Spanish write"yes" and "no" for di body.

Skip Di one wey oda users dey read well well and continue readingDi one wey oda users dey read well well
  • Di 11 NAF men wey bin dey arrested for Burkina Faso later regain freedom afta Nigeria's Foreign Minister bin go apologise to military President Ibrahima Traore.Nigeria Airforce crew wey dem bin detain for Burkina Faso don regain freedom, kontinue dia journey to Portugal
  • US Green card US suspend green card visa lottery scheme
  • FILE - fire service personnel clearing bees from a tree How bees attack, kill students and injure odas for Ghana school
  • Prof Dame Ijeoma Uchegbu stand for front, she wear coral jacket, light blue blouse, and light blue hat wit side brim. She dey smile. She hold one open long case wey contain di Dame Commander of di Order of di British Empire insignia. Di decoration get wide coral ribbon for di edge with silver and dem design am wit long cross wey get gold, silver, and light blue coloursDi Nigerian woman wey go from living for homeless shelter to becoming a world-renowned scientist

End of Di one wey oda users dey read well well

Di tori wey bin go round na say Charlie na Mexican child wey die. Some tori say na Mexican demon or pagan god or di victim of some kind of violent crime. But none of dis tori dey confirmed.

Even at dat, many pipo believe say Charlie na ghost or spirit from hell wey fit answer questions about whether your crush like you.

However, BBC Mundo correspondent Maria Elena Navez say no demon dey wey dem dey call "Charlie" for Mexico.

She say to describe di game as traditional Mexican way to call dead pipo na just way to hype am and make am sound mysterious.

Wetin dey make di pencil move?

One sabi pesin for Live Science Elizabeth Palermo explain say di pencils no balance well on top each oda, so, if small wind blow am, e go move.

She say na unstable structure wey dey bound to move.

  • Nigeria
  • Social media
  • Twitter
  • Jollificate
  • NIMC registration portal: how to link your MTN, Glo, Airtel, 9mobile sim with NIN

    ''Nigeria National Identity Number holders go pay money for services''

    6th January 2021
  • Trafficked pangolin for Kuala Lumpur

    Wetin you need to know about Pangolin and why some pipo dey 'rush' am

    6th January 2021
  • Di covid case for Nigeria don dey go high everiday and authorities dey worry say as di second wave don show like dis, plenti pipo dey at risk especially old pipo.

    ''Pfizer Vaccine to land Nigeria by end of January''

    5th January 2021
  • Public Holiday for Nigeria

    See Nigeria 2021 public holiday dates

    6th January 2021

Top Tori

  • Nigeria Airforce crew wey dem bin detain for Burkina Faso don regain freedom, kontinue dia journey to Portugal

    20th December 2025
  • 'We get call say e shoot imsef just 30 minutes afta my papa call us' - Family of officer wey dem link to bandits

    20th December 2025
  • Breakdown of Tinubu 2026 budget presentation wey go spend ₦15.52 trillion to service debt

    19th December 2025

Informate me

  • Anthony Joshua connects with right hand against Jake Paul

    Anthony Joshua knack stars comot for Jake Paul eyes

    20th December 2025
  • Prof Dame Ijeoma Uchegbu stand for front, she wear coral jacket, light blue blouse, and light blue hat wit side brim. She dey smile. She hold one open long case wey contain di Dame Commander of di Order of di British Empire insignia. Di decoration get wide coral ribbon for di edge with silver and dem design am wit long cross wey get gold, silver, and light blue colours

    Di Nigerian woman wey go from living for homeless shelter to becoming a world-renowned scientist

    18th December 2025
  • One man dey wear T-Shirt wit inscription for back "Pay Your Tax" dey walk down di stairs

    Na true say dem go block bank accounts wey no get TIN for January?

    18th December 2025
  • U.S. President Donald Trump dey tok for lectern, e wear navy suit wit red tie in front of a painting and flags

    Trump ban Burkina Faso, impose partial ban on Nigeria and oda kontris

    17th December 2025
  • Nnenna Ilobi wey wear cream colour blouse bin dey 24 years while Ijeoma Ilobi wey wear black bin dey 28 years.

    'Our sisters die for Sosoliso plane crash, till now we still dey fear to fly'

    16th December 2025
  • Godswill Akpabio wear sky blue cloth wit Navy blue cap and eyeglasses as e stand for red podium wit three different branded microphones.

    Senate ask NSA to chook eye as tori spread say Akpabio dey hospital for London

    16th December 2025
  • Peller

    FRSC to prosecute TikTok streamer Peller over reckless driving after viral video

    15th December 2025

Di one wey dem dey read well well

  1. 1Nigeria Airforce crew wey dem bin detain for Burkina Faso don regain freedom, kontinue dia journey to Portugal
  2. 2US suspend green card visa lottery scheme
  3. 3How bees attack, kill students and injure odas for Ghana school
  4. 4Di Nigerian woman wey go from living for homeless shelter to becoming a world-renowned scientist
  5. 5Breakdown of Tinubu 2026 budget presentation wey go spend ₦15.52 trillion to service debt

Tag » How To Play Charlie Charlie