How Nigeria Gain Independence - BBC News Pidgin
Maybe your like

Wia dis foto come from, Getty Images
On October 1, 2021, Nigeria go be 61 years but her journey to become kontri begin many-many years before her independence.
Wetin you sabi about how Africa most populous nation and how she get independence on October 1, 1960?
Before colonialism
Before Europeans come Africa, as early as 1100BC, different kingdoms and empires come settle for wetin today be Nigeria.
Some of di settlers na Kingdom of Nri, Benin Empire, Oyo Empire, Borno Empire plus Hausa kingdoms.
Kontinu to dey readAll dis different settlers bin dey do business wit each oda during dis time.
During colonialism and amalgamation
From 15th century - dat na between January 1, 1401 to December 31, 1500 - European slave traders enta Africa.
Dem sell Africans as part of di Atlantic or Transatlantic slave trade.
Inside di area wey today be Nigeria, di European slave traders first use Badagry port wey dey for Lagos to cari slaves.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue readingDi one wey oda users dey read well well
Blue film star Ron Jeremy dey face rape allegation
Prosperity, reverse jakpa, economic freedom and mourning full New Year prophecies by men of God for Nigeria and Ghana
'My health dey kampe' Donald Trump tok
'A time to heal' - Moyo Lawal tok about her sex video wey leak
End of Di one wey oda users dey read well well
Di slave trade last till di 19th century, dat na witin 1801 to 1900.

Wia dis foto come from, Getty Images
British forces enta Lagos for 1861 and afta di 1884/1885 Berlin conference, Lagos become British colony for 1886.
Southern Nigeria become British protectorate for 1900 and dem amalgamate (join) am wit Lagos colony for 1906.
Also for 1905, northern Nigeria become British protectorate.
Lord Lugard become di govnor general and on January 1, 1914, im join di north and south protectorate togeda to become one kontri, Nigeria.
Independence
During di British rule, fight-fight among di different regions for Nigeria make goment work difficult.
By 1951, dem divide di kontri into north, east and western region, each region wit im own house of assembly.

Wia dis foto come from, Getty Images
Britain kontinu to rule Nigeria until one act of di British parliament give Nigeria independence witin di commonwealth on October 1, 1960.
Dem come form new constitution wey arrange federal system wit elected prime minister and ceremonial head of state.
Di NCNC party, wey Nnamdi Azikiwe dey lead come collabo wit Abubakar Tafawa Balewa NPC party afta none of dem win majority for di 1959 elections.
Na so Balewa come dey serve as prime minister, while Azikiwe come be president of di Senate.
- Politics
- Nigeria
- Nigeria politics

Checkout how Nigeria plan to celebrate dia 61st Independence Day
30th September 2021
DSS deny killing of Dr Chike Akunyili
30th September 2021
Top Tori
Anthony Joshua driver charged to court ova fatal car crash for Nigeria - wetin be di offence
15 minutes wey don pass'My health dey kampe' Donald Trump tok
7 hours wey don passTinubu and oda world leaders New Year 2026 messages
1st January 2026
Informate me

Prosperity, reverse jakpa, economic freedom and mourning full New Year prophecies by men of God for Nigeria and Ghana
1st January 2026
Happy New Year! How countries enta 2026
1st January 2026
Guinea junta leader Gen Mamady Doumbouya win presidential election by landslide
31st December 2025
Who be di two pipo wey die for car accident wey involve Anthony Joshua
30th December 2025
Nollywood mourn actress Princess Allwell Ademola wey die at 49
28th December 2025
Christmas message from world leaders and how Christians celebrate around di globe
25th December 2025
Di beggar wit polio, wey learn to read at 16 and become 'miracle doctor' wey dey save lives
26th December 2025
Di one wey dem dey read well well
- 1Blue film star Ron Jeremy dey face rape allegationDe one we dem update for: 24th June 2020
- 2Prosperity, reverse jakpa, economic freedom and mourning full New Year prophecies by men of God for Nigeria and Ghana
- 3'My health dey kampe' Donald Trump tok
- 4'A time to heal' - Moyo Lawal tok about her sex video wey leak De one we dem update for: 16th October 2023
- 5Tiwa Savage and oda celebs wey face blackmail over sex tapeDe one we dem update for: 20th October 2021
Tag » How Did Nigeria Gain Independence
-
History Of Nigeria - Wikipedia
-
Independent Nigeria | Britannica
-
Nigeria Gains Independence From Britain - African American Registry
-
How Did Nigeria Gain Independence In 1960? - Nigerian Finder
-
Nigeria Gained Independence From The United Kingdom
-
11 Facts You Should Know About Nigeria As It Celebrates 60 Years ...
-
Nigeria Gained Her Independence | TODAY IN HISTORY - YouTube
-
How Did Nigeria Gain Independence? | Homework.
-
From Self-rule To Civil War: Nigeria's Independence, 60 Years On
-
The Fight For Nigerian Independence - The Guardian Nigeria News
-
The Road To Independence, 1957-1960 - De Gruyter
-
What Nigerian Independence Means - Jstor
-
33. Nigeria (1960-present) - University Of Central Arkansas