'In Need Of A Miracle' - Update On Pastor Gray Life-threatening Condition

'In need of a miracle' - Update on pastor Gray life-threatening condition
Relentless church pastor John Gray

Wia dis foto come from, Getty Images

12 July 2022New Informate 13 July 2022

Pastor John Gray, di founder of Relentless Church, one megachurch for Greenville, South Carolina, USA dey hospital in 'critical condition'.

Dem admit Gray into di critical care unit for one unnamed hospital wit a saddle pulmonary embolism with additional blood clots for im lungs. 

Aventer Gray, di wife of Pastor John Gray of Relentless Church don call on di christian community to keep her husband for dia prayers.

Pastor Gray wife tell her over 241 thousand followers on Instagram say she and her family "stand in need of a miracle."

Kontinu to dey read

She later come reveal say her husband dey hospitalized for pulmonary embolism, wey be blockage for one of more arteries inside di lungs.

"Hello family. My family and I stand in need of a miracle. Please keep my husband @realjohngray in your prayers," Aventer Gray write on Sunday.

Relentless Church, also write,"We believe in the POWER of PRAYER".

"And we dey believe God for a complete healing for our Pastor - Pastor John Gray" di church write ontop dia verified Facebook page.

Skip Di one wey oda users dey read well well and continue readingDi one wey oda users dey read well well
  • A picture of the sexologist Dr Ilana Eleá smiling at the camera with dark brown hair.  'Why I ask my husband for open marriage afta ten years'
  • Ron Kenoly wear one dark blue blazer with one blue sweat shirtGospel legend Ron Kenoly die at 81
  • One US Military officer and im Nigeria counterpart stand close to a military aircraft for hangerWetin we know about US 'small team' of troops wey dey Nigeria
  • Melinda French Gates and Bill Gates at an event together in 2017'Painful times for my marriage' - Melinda French Gates react to ex-husband in Epstein files

End of Di one wey oda users dey read well well

Aventer Gray tok about her husband condition

Aventer Gray say her husband, John Gray dey admitted immediately to di critical care unit (CCU).

E dey wit a saddle Pulmonary Embolism for di pulmonary artery and more lung blood clots, she tok.

"After feeling a little different over di past couple weeks, e go ER on Thursday evening and dey immediately admit am to CCU with...

"...a saddle Pulmonary Embolism for di pulmonary artery and more lung blood clots."

"Di Saddle PE dey in a position wey fit potentially end im life if e shifts at all."

"Di clot burden dey severe and only God dey hold am in place. E dey currently for CCU...

"...and based on CT and Echo we go need two types of surgery sake of di pressure now on di heart within the next 24 hours."

Aventer Gray continue to explain more about how di nature of her husband condition according to wetin doctor tok.

"To place dis in perspective, di doctor say pipo don bin come di hospital dead with dis exact scenario wey e waka enta hospitak with."

"Di Doctor say God gatz to keep am through di night and e no fit move, or even get up to waka go bathroom."

Skip content and continue readingKemi wey get Nigerian roots wan be UK Prime Minister, check who she be12th July 2022

End of content

Pastor Gray condition, why e be public mata

Since di announcement from Aventer Gray, plenti pipo from di christian community, oda pastors and leaders don share dia supportive thoughts for Gray and e family.

Actor and R&B singer Tyrese Gibson post one photo of Gray holding im newborn daughter for Instagram with message of support for di pastor and e wife.

Early today, di Aventer give more update about John gray health condition.

She write say 'leg clot don go, remaining lung clots wey need to disapear.'

Di motivational speaker wey dey popular get a million followers for im verified instagram page.

Im get massive following across di world.

For some, im health condition na test to dia Christian faith.

Some odas dey concerned say as pesin wey dey motivate odas, dem wish say im go quickly recover.

Pastor John Gray, Relentless Church get massive black American following.

In May 2022, pastor John Gray bin share one heartbreaking video say im bin no well for many years", only weeks before e dey hospitalized.

Im tok about im health challenges during one Instagram Live and tell im followers about di secret struggles e dey deal wit in life.

Wetin be pulmonary embolism?

Dis Image na Part Of one Series On Pulmonary Pathologies

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis Image na Part Of one Series On Pulmonary Pathologies

According to di Mayo Clinic, Pulmonary embolism na blockage for one of di pulmonary arteries for di lungs.

For most cases, pulmonary embolism dey caused by blood clots wey go travel to di lungs from deep veins inside di legs. or, rarely, from veins for oda parts of di body (deep vein thrombosis).

Dis na because di clots block blood flow to di lungs, pulmonary embolism fit dey life-threatening.

However, quick treatment dey greatly reduce di risk of death.

Mayor Clinic advise say taking measures to prevent blood clots for legs fit help protect pesin against pulmonary embolism.

Common signs and symptoms of Pulmonary embolism include shortness of breath, chest pain, leg pain or swelling.

Rapid or irregular heartbeat, fever, excessive sweating and a cough wey fit produce bloody or blood-streaked (mucus) na also symptom.

Who be John Gray?

John Gray na di senior pastor of Relentless Church for Greenville, South Carolina.

Gray dey still serve as a teaching voice for Lake wood Church for Houston, Texas.

Dem born Pastor John Gray for Cincinnati, Ohio and im currently dey reside for Greenville with im wife Aventer and dia two pikin.

Im kids na John Gray IV (four) and Theory Aspyn-Sky Gray (Tutu).

According to informate from di John Gray website, e be two-time published author of di "I am Number 8" and "Win from within".

E perform for di hit docu-series, "Di book of John Gray" wey dem show for di Oprah Winfrey Network.

John establish Relentless Church in 2018. Before e create am, he serve as an associate pastor for Joel Osteen Lakewood Church, according to CBN News.

Skip content and continue readingNetflix confirm Busi Lurayi death, manager tok how she 'suddenly' die 11th July 2022

End of content

  • America
  • Religion

Ginger Me

  • A lady singing with a microphone02:32 Video, ‘I neva accept say Ifunanya don die’, Duration 2,32
  • Tyla holding her Grammy Award01:29 Video, Record-breaking moment for 2026 Grammys, Duration 1,29
  • Ifunanya Nwagene01:32 Video, Who be fast-rising singer Nanyah wey snakebite kpai, Duration 1,32
  • Inside Nigeria biggest dog market01:27 Video, Inside Nigeria biggest dog market, Duration 1,27
  • A man describing the extent of damage at Solid Worth Hotel in Offa, Kwara State02:03 Video, Offa residents count losses one month afta US airstrikes, Duration 2,03
  • Diezani Alison-Madueke01:40 Video, Trial of ex-Nigerian petroleum minister Alison-Madueke, Duration 1,40
  • A man wears a blue jacket and holds a microphone02:51 Video, 'My hope in Africa no dey in di leaders' - M.anifest, Duration 2,51
  • Coups in Nigeria01:24 Video, Nigeria coup plotters and wetin later happun to dem, Duration 1,24
  • Nnamdi Kanu00:48 Video, Sit-at-home: Traders chant songs in support of Nnamdi Kanu, Duration 0,48
  • Abuja protest00:45 Video, Angry workers for Abuja chase Wike car, Duration 0,45
Osinachi husband no escape Kuje prison

Late Osinachi husband no escape for Kuje prison break - NCS

12th July 2022

Top Tori

  • Wetin we know about US 'small team' of troops wey dey Nigeria

    7 hours wey don pass
  • 'Painful times for my marriage' - Melinda French Gates react to ex-husband in Epstein files

    one hour wey don pass
  • Wetin be di next tin for leader of South Africa second largest party wey comot from DA leadership?

    3 hours wey don pass

Informate me

  • One pesin hold phone to her ear as she dey waka pass one street for Noida. She wear face mask. Tuk tuks wey dey drive down di street dey for di background. Dem take di foto for November 2025.

    Seven million cancers yearly dey preventable as report list contributors to more dan 18 million cancer cases

    one hour wey don pass
  • Foto of camel and dia sample of passport wey Saudi Arabia wan do

    Saudi Arabia launch passport for camels

    3 hours wey don pass
  • Ron Kenoly wear one dark blue blazer with one blue sweat shirt

    Gospel legend Ron Kenoly die at 81

    3rd February 2026
  • A picture of the sexologist Dr Ilana Eleá smiling at the camera with dark brown hair.

    'Why I ask my husband for open marriage afta ten years'

    3rd February 2026
  • Di preacher failed prophecy bin generate a lot of backlash on social media

    Popular Ghana Prophet ElBernard say e go 'stop' public preaching afta im give prophecy wey fail

    3rd February 2026
  • Trevor Noah wear purple suit for di Grammys.

    Trump threaten to sue Trevor Noah on top Epstein joke for Grammys

    2nd February 2026
  • A man and a woman embracing each other

    Four important questions to ask yoursef bifor you enta friendship wit your ex

    1st February 2026

Di one wey dem dey read well well

  1. 1'Why I ask my husband for open marriage afta ten years'
  2. 2Gospel legend Ron Kenoly die at 81
  3. 3Wetin we know about US 'small team' of troops wey dey Nigeria
  4. 4'Painful times for my marriage' - Melinda French Gates react to ex-husband in Epstein files
  5. 5Popular Ghana Prophet ElBernard say e go 'stop' public preaching afta im give prophecy wey fail

Tag » Where Is Pastor John Gray Now 2021