'In Need Of A Miracle' - Update On Pastor Gray Life-threatening Condition
Maybe your like

Wia dis foto come from, Getty Images
Pastor John Gray, di founder of Relentless Church, one megachurch for Greenville, South Carolina, USA dey hospital in 'critical condition'.
Dem admit Gray into di critical care unit for one unnamed hospital wit a saddle pulmonary embolism with additional blood clots for im lungs.
Aventer Gray, di wife of Pastor John Gray of Relentless Church don call on di christian community to keep her husband for dia prayers.
Pastor Gray wife tell her over 241 thousand followers on Instagram say she and her family "stand in need of a miracle."
Kontinu to dey readShe later come reveal say her husband dey hospitalized for pulmonary embolism, wey be blockage for one of more arteries inside di lungs.
"Hello family. My family and I stand in need of a miracle. Please keep my husband @realjohngray in your prayers," Aventer Gray write on Sunday.
Relentless Church, also write,"We believe in the POWER of PRAYER".
"And we dey believe God for a complete healing for our Pastor - Pastor John Gray" di church write ontop dia verified Facebook page.
Skip Di one wey oda users dey read well well and continue readingDi one wey oda users dey read well well
Malema return to court for pre-sentencing sake of firearm case
'We wan see di end of dis kain violence' - US tell Nigeria afta kidnap of over 150 Churchgoers for Kaduna
Kurmin Wali residents accuse authorities of cover-up afta jaguda pipo kidnap more dan 150 pipo from three Churches
Why Tonto Dike reconcile wit her ex-husband Olakunle Churchill
End of Di one wey oda users dey read well well
Aventer Gray tok about her husband condition
Aventer Gray say her husband, John Gray dey admitted immediately to di critical care unit (CCU).
E dey wit a saddle Pulmonary Embolism for di pulmonary artery and more lung blood clots, she tok.
"After feeling a little different over di past couple weeks, e go ER on Thursday evening and dey immediately admit am to CCU with...
"...a saddle Pulmonary Embolism for di pulmonary artery and more lung blood clots."
"Di Saddle PE dey in a position wey fit potentially end im life if e shifts at all."
"Di clot burden dey severe and only God dey hold am in place. E dey currently for CCU...
"...and based on CT and Echo we go need two types of surgery sake of di pressure now on di heart within the next 24 hours."
Aventer Gray continue to explain more about how di nature of her husband condition according to wetin doctor tok.
"To place dis in perspective, di doctor say pipo don bin come di hospital dead with dis exact scenario wey e waka enta hospitak with."
"Di Doctor say God gatz to keep am through di night and e no fit move, or even get up to waka go bathroom."
Skip content and continue readingKemi wey get Nigerian roots wan be UK Prime Minister, check who she be12th July 2022End of content
Pastor Gray condition, why e be public mata
Since di announcement from Aventer Gray, plenti pipo from di christian community, oda pastors and leaders don share dia supportive thoughts for Gray and e family.
Actor and R&B singer Tyrese Gibson post one photo of Gray holding im newborn daughter for Instagram with message of support for di pastor and e wife.
Early today, di Aventer give more update about John gray health condition.
She write say 'leg clot don go, remaining lung clots wey need to disapear.'
Di motivational speaker wey dey popular get a million followers for im verified instagram page.
Im get massive following across di world.
For some, im health condition na test to dia Christian faith.
Some odas dey concerned say as pesin wey dey motivate odas, dem wish say im go quickly recover.
Pastor John Gray, Relentless Church get massive black American following.
In May 2022, pastor John Gray bin share one heartbreaking video say im bin no well for many years", only weeks before e dey hospitalized.
Im tok about im health challenges during one Instagram Live and tell im followers about di secret struggles e dey deal wit in life.
Wetin be pulmonary embolism?

Wia dis foto come from, Getty Images
According to di Mayo Clinic, Pulmonary embolism na blockage for one of di pulmonary arteries for di lungs.
For most cases, pulmonary embolism dey caused by blood clots wey go travel to di lungs from deep veins inside di legs. or, rarely, from veins for oda parts of di body (deep vein thrombosis).
Dis na because di clots block blood flow to di lungs, pulmonary embolism fit dey life-threatening.
However, quick treatment dey greatly reduce di risk of death.
Mayor Clinic advise say taking measures to prevent blood clots for legs fit help protect pesin against pulmonary embolism.
Common signs and symptoms of Pulmonary embolism include shortness of breath, chest pain, leg pain or swelling.
Rapid or irregular heartbeat, fever, excessive sweating and a cough wey fit produce bloody or blood-streaked (mucus) na also symptom.
Who be John Gray?
John Gray na di senior pastor of Relentless Church for Greenville, South Carolina.
Gray dey still serve as a teaching voice for Lake wood Church for Houston, Texas.
Dem born Pastor John Gray for Cincinnati, Ohio and im currently dey reside for Greenville with im wife Aventer and dia two pikin.
Im kids na John Gray IV (four) and Theory Aspyn-Sky Gray (Tutu).
According to informate from di John Gray website, e be two-time published author of di "I am Number 8" and "Win from within".
E perform for di hit docu-series, "Di book of John Gray" wey dem show for di Oprah Winfrey Network.
John establish Relentless Church in 2018. Before e create am, he serve as an associate pastor for Joel Osteen Lakewood Church, according to CBN News.
Skip content and continue readingNetflix confirm Busi Lurayi death, manager tok how she 'suddenly' die 11th July 2022End of content
- America
- Religion

Late Osinachi husband no escape for Kuje prison break - NCS
12th July 2022Top Tori
'Dem kill half of my friends' - Twins wey witness attacks on dia school tok
24th January 2026Court adjourn indefinitely suit wey challenge impeachment of Govnor Fubara, Deputy
23rd January 2026'We wan see di end of dis kain violence' - US tell Nigeria afta kidnap of over 150 Churchgoers for Kaduna
23rd January 2026
Informate me

Who be alleged drug kingpin Ryan Wedding compared to Pablo Escobar wey FBI gbab
23rd January 2026
Malema return to court for pre-sentencing sake of firearm case
23rd January 2026
Tinubu withdraw posting of former govnor of Kebbi State as ambassador to Turkey
23rd January 2026
Why some pipo dey addicted to gambling
21st January 2026
Why Trump 'Board of Peace' dey so controversial
21st January 2026
Wetin don happun since police confam kidnap of over 100 Church goers for Kaduna
21st January 2026
'My family dey disrespect my wife' - David Beckham son Peltz say im no wan settle wit im family
20th January 2026
Anthony Joshua driver appear in court afta accident wey kill two pipo
20th January 2026
Di one wey dem dey read well well
- 1Malema return to court for pre-sentencing sake of firearm case
- 2'We wan see di end of dis kain violence' - US tell Nigeria afta kidnap of over 150 Churchgoers for Kaduna
- 3Kurmin Wali residents accuse authorities of cover-up afta jaguda pipo kidnap more dan 150 pipo from three Churches
- 4Why Tonto Dike reconcile wit her ex-husband Olakunle Churchill
- 5Tiwa Savage and oda celebs wey face blackmail over sex tapeDe one we dem update for: 20th October 2021
Tag » Where Is John Gray Now 2021
-
Online - Relentless Church
-
John Gray (@realjohngray) • Instagram Photos And Videos
-
John Gray And Relentless Church Through The Years: Before Atlanta
-
Pastor John Gray Welcomes Crowd To Relentless Church In Atlanta
-
Pastor John Gray Remains In Critical Condition
-
Relentless Now
-
2022 - Pastor John Gray | Latest Updates - Naijapage
-
John Gray Live Stream 2022 - Sermons Online
-
Pastor John Gray April 4, 2021 - Resurrection At Relentless - YouTube
-
Pastor John Gray Shuts Down Cheating Allegations Again
-
Pastor John Gray Leaves Hospital Following Life-Threatening Blood ...
-
Pastor John Gray Is Back On Pulpit After Suffering Embolism But ...
-
John Gray Needs A Miracle — EEW Magazine